March 28, 2024

Wia dis foto come from, EFCC/INSTAGRAM

Wetin we call dis foto,

EFCC

Nigeria corruption police wey be Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) say dem don arrest one Osondu Igwilo wey be suspected International “catcher”.

EFCC gbab Osondu wey don dey ontop FBI list since 2018 and three oda pipo for alleged one hundred million dollars fraud.

Na on Thursday March 11, 2022 dem arrest Osondu and im members for one studio for Sangotedo area for Lagos State, southwest Nigeria.

Wetin Osondu and im “catchers” gang dey allegedly do?

According to EFCC di criminal gang allegedly dey into fraud, money laundering, and identity theft to di tune of one hundred million dollars.

Dem allegedly dey involved for advanced fee scheme like fake promises say dem go fund di investment of individuals.

Dem also impersonate some of di United States of America, USA bank officials physically and through internet.

Osondu na di alleged ring leader of International investment scam.

Osondu criminal record for United States

No be today Osondu and im gang members mata start.

FBI afta dem investigate am charge Osondu go court for di Southern District of Texas, USA for December 18, 2018 afta e allegedly defraud pipo for more dan twenty kontris of more dan sevem million dollars.

Di scam allegedly be say e dey tell im victims say dem need to pay certain amount of money before di US bank fit fund dia investments.

Di money wey e make through di process e…

Read more…

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *